Sagot :
Answer:
Odas say na attempt to return to a kind of new cold war.
Tensions between Russia and Ukraine don trigger red flags in many foreign ministries around di world.
Russia launch a major military assault against Ukraine early Thursday 24 February, 2022.
Moscow launch di invasion despising international beg-beg for peace and di threat of severe punishment from di West.
Explosions na im pipo don dey hear across Ukraine, from di capital Kyiv to Kramatorsk and Mariuopol, close to di front-line with Russian-backed separatists or di Donbas.
President Vladimir Putin order di invasion inside a televised speech at 05:55 Moscow time (02:55 GMT).
Putin say Moscow response go be "instant" if anyone try to take on Russia.
Ukraine foreign minister don accuse Russia of starting a full-scale war.
Dmytro Kuleba want di UN "to do everything possible" to stop wetin dey happun.
Ukraine President Volodymyr Zelensky in a television message say di Russian president no return him call on Wednesday evening.
Di Kremlin dey demand say make Ukraine promise never to join NATO.
Moscow also want Kiev to set limits on di troops and armaments wey dem fit deploy inside kontris wey join dis alliance afta di fall of di Soviet Union.
President Vladimir Putin goment dey also demand di withdrawal of military infrastructure dem install inside Eastern European states afta 1997.
"Dem really want to return to di borders wey bin dey exist in Eastern Europe during di Cold War," na wetin George Friedman tok.
Friedman na di founder of di international foresight and analysis firm Geopolitical Futures, and im bin dey summarize Moscow demands